Oil Sellers Don Cum Out Tok Say Dem Go Add Money For Petrol Price To N720/Liter

9 months ago
Please Share to your Social Media
Please Follow Naijamerit on Social Media
News Home More from Hot Tori

Oil sellers for obodo naija don warn say di fuel price fit add money anytime soon, and e go dey between N680 and N720 per liter.

Dis na becuase say di way naira don dey weak against dollars, on top di foreign exchange scarcity mata.

Dis fuel bin don dey sell for about N910 and N950 for black market for some days now.


Pepo wey dey deal wit dis petroleum products nor fit import wetin dem bin oda because of dis wahala wey dey.

Di Central Bank of Nigeria's Importers and Exporters (I & E) foreign exchange window don fit lower di exchange rate small small dan wetin dey di black market, but oil industry pepo dem tok say di market sef nor fit produce di  $25 million to $30 million wey suppose dey for di daily petrol importation. 


Dem don dey tok say di way petrol go add money nor be sumtin we go fit escape if naira rate nor add.

Leaders of key oil industry associations, join di Major Oil Marketers Association of Nigeria, di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, and di Petroleum Products Retail Outlets Owners Association of Nigeria, don com out tok say make federal government sef chook mouth for di mata.


How una see dis mata??
#Chookmouth

More from Hot Tori

FIFA Women's World Cup: James Don Get Two-Match Ban for Di Alozie Stamp

Di Federation of International Football Association (FIFA) don knack England dia Round of 16 clash with Nigeria for Brisbane on Monday. Di Federation of International Football Association (FIFA) don knack England dia Round of 16 clash with Nigeria for Brisbane on Monday.

SERAP Go Sue Akpabio On Top Di‘Holiday Allowances’

Di Socio-Economic Rights and Accountability Project (SERAP) tok say e go sue Senate President Godswill Akpabio on top say him dey give “holiday allowances” to senators by di Clerk of the National Assembly.

Two people die, Five oda people injure for Eko Bridge Accident.

Two people die for inside accident wey involve six private cars for Eko Bridge on Wednesday.

Tinubu Don Order New Sanctions on Top Niger

Presido Bola Tinubu don tell di acting governor of di Central Bank of Nigeria (CBN) to knack new financial sanctions to di ones wey first dey on top Niger Republic.

Nigerians Dey React as Adamawa Governor Appoint 47 Media Aides

Pipo don dey react follow di appointment of 47 media aides by Governor Ahmadu Fintiri of Adamawa State.

NLC Don Suspend Di Strike Afta Presido and Senate Chook Mouth

Di National Labour Congress (NLC) don suspend dia planned strike afta Presido Bola Tinubu chook mouth come get emergency meeting with di Senate.

16 Join Bodi For North No Gree Follow NLC Protest Today

16 Northern joinbodi no go join NLC for dia strike.

UPDATE: NLC Protest Don Start

NLC protest don start for different parts of di kontri.


Read full article
Please Follow Naijamerit on Social Media
< Back | News content